Business

How Elon Musk become world first half-trillionaire

By Ghana News

Copyright ghanamma

How Elon Musk become world first half-trillionaire

Tesla boss Elon Musk don become di first pesin ever to achieve net worth wey pass $500bn (£370.9bn), as di value of im electric car company and im oda businesses rise dis year.

Di tech magnate net worth briefly reach $500.1bn on Wednesday afternoon New York time, bifor e drop small to just ova $499bn later in di day, di Forbes billionaires index report.

Alongside Tesla, valuations of im oda ventures, wey include di artificial intelligence startup xAI and rocket company SpaceX, also reportedly go up recent months.

Dis milestone don further cement Musk status as di world richest pesin, well ahead of rivals for di global tech sector.

According to Forbes billionaires index, Oracle founder Larry Ellison na di world second richest pesin, wit fortune of about $350.7bn.

Oga Ellison bin briefly overtake Musk last month afta shares for Oracle rise by more dan 40%, wey di firm surprisingly rosy outlook for dia cloud infrastructure business and artificial intelligence (AI) deals boost.

Musk big wealth dey closely tied to im more dan 12% stake for Tesla, wey di shares rise sharply dis year.

Tesla shares bin dey more dan 3.3% higher for di end of New York trading on Wednesday and now e don rise by ova 20% dis year.

Di company shares don dey make gains in recent months as investors welcome Musk as e dey focus more time on im companies instead of politics.

E face criticism earlier dis year sake of im work wit US President Trump administration Department of Government Efficiency (DOGE), di body wey dey tasked wit reducing US govment spending and cutting jobs.

Musk, wey also get di X social media platform, dey very vocal about im views on issues like immigration and diversity, equity, and inclusion (DEI) programmes.

Wetin be Elon Musk net worth?

Di chair of Tesla board, Robyn Denholm, bin tok for September say Musk dey for di “front and centre” now for carmaker.

Di company board also say Musk fit receive pay package wey worth ova $1tn if e hit list of ambitious targets ova di next decade.

To get di package, e go need to boost Tesla value by eightfold, sell one million AI robots, sell anoda 12 million Tesla cars, plus hit several oda goals.

Also last month, Musk announce say im buy about $1bn worth of Tesla shares for wetin some investors see as vote of confidence for di firm.

Tesla bin face plenty challenges in recent years, wey include tough competition from rival electric car makers like China BYD.

Di company also dey di process of transitioning into AI and robotics business.

Musk also dey champion digital currencies and e get hand for several oda smaller companies, wey include tunnel-maker di Boring Company.

Musk, wey wear di mantle of a workaholic proudly, dey always tok say im no dey do business just to make money – claims wey e repeat recently wit regard to im Twitter takeover.

“Elon dey only involve imsef wit tins e feel say dey very important for some reason… for di sake of society or humanity,” im friend and Tesla investor Ross Gerber tok.